fbpx
April 26, 2024

Obi boast to win for S/West, as hin show face for Ibadan

0

Di Presidential candidate of the Labour Party, LP, Mr. Peter Obi, yesterday, don come out stand against di rumour wey dey tok say hin no fit secure any votes for South-West.

Obi, who don alreadi declare himself di most qualified person to rule Nigeria at di first and second convocation ceremonies of di Dominican University, Ibadan.

U FIT ALSO READ Buhari Don Go Washington For US-Africa Leaders Summit

Obi tok say pipol go vote for ram base on say hin get all di qualities to move the countri to di promised land.

Hin tok say: “ hin number one structure na God, di number two  na human being, and you pipol na my structure base on say you pipol believe in me.

If dem dey tok say I dey give unverified statistics tell dem say make dem bring dia own make we see. Dem no fit just sit down for one corner like dat con dey tok say I dey give wrong statistics, without prove.

Obi, wey bi Pro-Chancellor of di university, tok say hin don alreadi prove say hin fit do di job, as hin tok say: “ hin no dey make promises on wetin him no fit do.

Obi tok say “ hin go invest in health and education. hin go start from basic education to make sure say pipol been dey educated fo basic level. For di tertiary level, hin go create system wey go make am work well without di students going on strike.”

Hin tok say: “Ibadan as a city need di federal attention. Oyo too big pass wetin you fit use mouth analyze. infact Ibadan na big city, wey you fit compare with Lagos in term of population.

Ibadan na betta state to invest in education. becos say many tertiary schools plenti for dier. Bifore Bifore Pipol bin dey visit College of Medicine for Ibadan. But Today, reverse is di case.

To read di full tori CLICKHERE

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *