fbpx
April 26, 2024

2023: Voting for Atiku or Obi dey more dangerous – Tinubu tell Nigerians

Di presidential candidate of the All Progressives Congress, APC,Bola Ahmed Tinubu don describe hin major opponents as pipol wey dem no fit entrust di future 9f di countri for dia hands.

Tinubu bin tag Peter Obi of Labour Party, LP, and Atiku Abubakar of the Peoples Democratic Party, PDP, as Mr. Stingy (Obi) and Mr. Privatilization (Atiku).

U FIT ALSO READ Kwankwaso say politics of ethnicity go fail 

Hin yarn dis one during one rally for Ondo State.base on say na baba tinubu dey always champion di progressive and people-oriented administration, Tinubu tok say hin challenge di pipol of di state to stand up and support APC in every way for di forthcoming election.

Tinubu wey bi APC presidential candidate yarn dis one on Saturday during di campaign rally for Democracy Park inside Akure, wey bi di state capital.

Hin tok say di true difference beetwin hin own leadership and dat of Mr. Obi na base on observation.

Although Lagos dey crowded and Anambra no get much population and dey get more space, but more pipol comot for Anambra wey bi Obi state con dey seek for better life for Lagos wey bi Tinubu state.

Tinubu tok say,“My pipol My pipol, no matter how long lizard stay indide river e no fit turn crocodile.you fit entrust your future or that of our nation to Mr. Sell Everything Atiku or Mr. Stingy Obi.”

But as for Mr. Progressive Good Governance trust me na.”with me your future is assured and your countri is about to witness wetin i call transformation.”

To read di full tori CLICKHERE