fbpx
May 5, 2024

Resist vote selling, CAN advice youths

resist-vote-selling

Di christian Association of Nigeria don call youths make dem resist vote selling for di upcoming general elections.

Secretary General, CAN Youth Wing FCT chapter, Mr. Joseph Daramola, make di call for di mega youth conference for Abuja on Sunday.

Na why dem encourage all youths make dem stand dia ground.

He tell youth say If anybody want bribe dem, make dem say no! If anybody want make dem sell dia vote, make dem say no!

Damarola explain say every political party get di right to choose any person wey dem want as running mate, same faith or not.

FOR MORE NEWS: 2023: Voting for Atiku or Obi dey more dangerous – Tinubu tell Nigerians

Dem dey always encourage dia pipo make dem resist vote selling and make dem vote with dia conscience.

Damarola say CAN dey against any offer of inducement just to gain dia support, he add say di organisation dey impartial and objective.

Hin tok be say if good christians and muslims participate in politics, di field of politics go clean.

To resist vote selling na one way to start di process.

You go like go read di full tori…READ MORE