fbpx
December 22, 2024

2023: Am di stepping stone to Ndigbos presidency, “seh you dey whine me ni” – Fani-Kayode blast Atiku

0
Fani-Kayode-

Fani-Kayode of di All Progressives Congress, APC, don come out tok say di Peoples Democratic Party, PDP, presidential candidate, Atiku Abubakar dey yarn nonsense for mouth.base on say hin tok say him bi stepping stone to Igbo presidency.

Fani-Kayode tok say Atiku who don fail for presidency race for di past 30 years, no fit come out dey tell pipol say hin bi di stepping stone to Igbo presidency.

U FIT ALSO READ Harass APC voters, face full wrath Of law, Omo-Agege warn political parties for Delta state

Atiku wey bi promise Ndigbos say hm go favour dem if hin become Nigeria elected president for 2023. during hin campaign rally for Anambra State.

Reacting to wetin Atiku tok Fani-Kayode tok say nobody fit stop Igbo pipol from producing president wen dia time reach. and if Atiku repeat dat word of stepping stone again hin fit call Amadioha give am.

Inside one Facebook post Fani-Kayode describe Atiku as persin wey dey too arrogant. di former Aviation Minister tok say: “ Seh Atiku think say di Ndigbos need am to become President for dem ni? You wey you don dey try to bi President for over 30 years now and you neva succeed. Seh na you con dey tok say you wan bi stepping stone for anoda persin. Seh you dey whine mi ni?.

Fani-Kayode tok say,“ Oga Atiku biko go gather your sense together and open your ear to hear wetin i wan tok, wen di time reach for di Ndigbos to become President of dis countri no one fit stop dem.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *