fbpx
May 19, 2024

Rape: court sentence Two undergraduate student of unilorin to death

0

Kwara State High Court wey dey for Ilorin preside by Justice Ibrahim Yusuf on Tuesday don sentence two students, Abdulazeez Ismail and Ajala Oluwatimileyin, to death for di murder of one 300-level undergraduate student of UnIlorin, wey her name bi Blessing Olajide.

Di two guys rape Olajide finish con still kill her on June 2, 2021, for her sister house for Tanke area of Ilorin, Kwara State.

U FIT ALSO READ Sexual assault referral centre don dey Cross River

Justice Yusuf also sentence anoda student, wey hin name bi Oyeyemi Omogbolahan, to life imprisonment, while two siblings: wey dia name bi Abdulkarim Shuaib (aka Easy) and Kareem Rasheed (Rashworld), court sentence dem to three years’ imprisonment each base on say dey withdraw money from olajire GTB account few days after she don kpai.

Court discharge: Abdullateef Abdulrahman, Daud Adebayo (Bashman) and Akande Oladoja.

Delivering of judgement on 11 counts of conspiracy, armed robbery, rape, culpable homicide and stealing of funds preferred against the eight accused pipol.

Justice Yusuf tok say di three students bin dey guilty of conspiracy, rape and murder of Olajide, while di two other telephone repairers who help dem unlock her telephone and assist dem to withdraw money from her account don also commit offence of conspiracy and stealing

Di judge, tok say na 13 pipol testify to di prosecution, while 16 pipol witnesses am, including di accused persin.

Justice Yusuf tok say, “ Di prosecution don already establish di ingredients of conspiracy and armed robbery against di three of dem, and without any doubt dey injure Olajide at di same time con still rape her to death.

Di judge con give order of hanging to death to Abdulazeez Ismail and Ajala Moses Oluwatimileyin.

Di prosecution counsel wey bi former Attorney General and Commissioner for Justice, Salman Jawondo,yarn tori pipol after di court session, say, “ why e bi like say na soso young pipol dey involve for dis rape matter from age 19, 23, and above.

She con tok say no bi wetin good at all and dis one don show say we need to work on di future of di countri if not everything go turn yam pepper scatter scatter.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *