fbpx
November 16, 2024

“Pipo dey Worship Money Ooo” – Netizens Reacts as Man Kiss Billionaire, E-Money Feet

man-kiss-billionaire-e-money-netizens-don-react

One Nigerian man don leave plenty pipo disappointed after hin do di unexpected to billionaire, Emeka Okonkwo wey dey better known as E-Money. Inside one video wey dey make rounds, di man bow down to kiss billionaire E-money for hin feet and hand.

Di man declare how much he love di billionaire and how hin don dey follow am bumper to bumper for weeks.

As hin dey tok for hin dialect (Igbo), he sing di praises of E-Money.

However, di video don cause mixed reactions as plenty pipo yarn say di man no do well for bowing to hin fellow man.

FOR MORE NEWS: Chidi Mokeme celebrate Ini Edo on her 41st birthday with loved-up photos

One Guddy Beauty yarn say, “No matter my circumstances. Goodness can never do this to a man if not my creator

One Melvo Official write, “That’s not a sign of loyalty or respect though

One Rubymone write, “Men, na so una dey do with una fellow men?

One Iam_zaiiiii write, “It has been officially proven people worship money more than God himself. Sad reality

One Raquel’s Gallery write, “Hope y’all can see how men behave when they’re with their fellow men with money? They’re worse than women

One Ubauju write, “See a person’s future husband disgracing himself

One Sean Frizzle write, “But the man no fit do that for him, pastor

E no dey surprising to see as di man bow to kiss billionaire E-money, because hin dey known for hin generosity.

You fit go read di tori…READ MORE