Actor Jared Leto dress like cat go di 2023 Met Gala
Jared Joseph Leto, an American actor and musician wey pipo know for hin method of acting different roles, dress as cat go di 2023 Met Gala. Hin make plenty pipo confused about hin identity.
Di dress code of di evening, wey dem host for New York Metropolitan Museum of Art, bin dey “In honour of Karl”. Dat one mean say celebrities bin dey inspired by late Chanel designer Karl Lagerfeld.
However, Leto outfit na more of an homage to Lagerfeld beloved pet, Choupette, than di man himself.
FOR MORE NEWS: Actress Ruby Ojiakor don reacts after pipo mock her over kitchen and old utensils
Before Jared Leto reveal say na him dey undey di larger-than-life cat suit for di 2023 Met Gala, hin hug Lizzo for di red carpet on Monday.
After hin comot di head of hin costume, Leto start to laugh with other for di carpet, including hin WeCrashed costar, Anne Hathaway.
You fit go read di tori see more pictures as Leto dress as cat go 2023 Met Gala….READ MORE