Wahala hit Imo PDP as seven SWC members resign
Seven members of di Imo State Working Committee (SWC) of di Peoples Democratic Party PDP, don resign from dia different positions dump di party.
Di officials announce dia resignation inside statement wey dem sign together. Na Collins Opurozor, di Imo PDP State publicity secretary, on Sunday for Owerri, di Imo State capital na hin make di tori available to reporters.
Also, di pipo wey resign na Sir Martins Ejiogu, deputy chairman, Ray Emeana, secretary, and Greg G.O.C. Nwadike, youth leader.
FOR MORE NEWS: “Person poison me for PDP Secretariat, my liver and kidney shut down” – Wike
Also, others na Collins Opurozor, publicity secretary; Mrs Maria Mbakwe, women leader; Josiah Eze, treasurer; and Chibuisi Obido, vice chairman, Orlu Zone.
Di group of seven members of di Imo PDP SWC wey resign claim say no indication dey say Senator Anyanwu dey run for governorship for November.
In addition, on why dem resign dia positions, di party officials yarn say e dey heartbreaking to inform pipo say some of dem for di State Working Committee don escape assassination attempts. Hin tok say na because of di wicked lies wey dia National Secretary sell to hin violent supporters, say dem misappropriated party funds.”
You fit go read di tori…READ MORE