fbpx
May 4, 2024

“Person poison me for PDP Secretariat, my liver and kidney shut down” – Wike

wike-say-dem-poison-am

Former Governor Nyesom Wike of Rivers State, on Sunday, reveal say dem poison am for secretariat of di Peoples Democratic Party, PDP, for 2018.

Wike yarn say di poison affect hin liver and kidneys, also, hin add say di thing almost kill am but God intervene.

He reveal dis tori during special Thanksgiving service wey bin dey organised by hin family for di St. Peters Deanery, Rumuepirikom, Obio-Akpor area of di state.

Di former governor yarn say dem fly am go Beirut for midnight, where doctors inform am say hin liver and kidneys don go.

 

FOR MORE NEWS: “I no go refund dat money” – Ruby Orjiakor lambast Destiny Etiko

 

According to wike, after hin attend to am, di doctors inform am say di organs no dey work again.

In addition, he yarn say na after one week na hin di doctors discharge am make hin go return house.

Di former Governor yarn say everybody turn to suspect as hin decide say hin no go enter any party leader house during di course of hin campaigns.

You fit go read di tori as Wike reveal say dem poison am…READ MORE