fbpx
May 4, 2024

Peter Obi legal team na embarrassment – Omokri claim

obi-legal-team-na-embarrassment

Reno Omokri, wey be popular social commentator, don claim say di legal team of Peter Obi of di Labour Party for di Presidential Election Petition Tribunal na embarrassment.

Omokri, media aide to ex-president Goodluck Jonathan, reveal dis tori via hin official Twitter handle on Saturday.

Omokri, wey be very strong supporter of Atiku Abubakar of di Peoples Democratic Party, PDP, yarn say hin dey disappointed at di nature of di witnesses and evidence wey Obi legal team bring before di Tribunal.

He claim say  Obi counsels dey make ‘schoolboy errors’ as dem dey make mistake with dia schedule of documents and as dem dey ask for more time.

 

FOR MORE NEWS: Wahala hit Imo PDP as seven SWC members resign

 

I addition, hin yarn say di way wey Obi team dey go about di petition, e no go yield results.

Hin tok say Peter Obi legal team and dia witnesses for di Presidential Election Petition Court na embarrassment.

On Friday, Peter Obi present additional witnesses to Tribunal to prove say President Bola Ahmed Tinubu no win di 25th February election.

You fit go read di tori…READ MORE