Pete Edochie drag Ireti Doyle, and others for divorcing dia husbands
Veteran Actor, Pete Edochie, inside chat with well-known media personality, Chude Jideonwo, no hold back hin emotions on how hin feel about di divorce rates wey dey increase inside di world of Nollywood.
Inside jaw-dropping revelation, di seasoned actor express how di matter shock as hin hear di broken marriages of hin female colleagues, Ireti Doyle, Tonto Dikeh, and Chioma Akpotha.
Also, hin tok say pipo wey dey enter marriage need to understand di sacred essence of marriage as an unyielding commitment, wey suppose to weather both di good and tough time.
According to wetin hin tok, if person look Nollywood Industry today, dem go see say most of di ladies wey marry 2- 3 years ago don comot for dia husbands house. Hin even tok say e shock am when he hear say Chioma Chukwa don divorce her husband, Ireti Doyle, Tonto Dikeh dey di same boat too.
FOR MORE NEWS: Why I dumped law for music” – The Cavemen Kingsley don open up
Inside emotionally charged moment, Pete pour hin heart out about di talented actresses wey portray hin daughters for silver screen.
Among dem, hin single out Genevieve Nnaji. Also, hin hail her say she dey brilliant.
Pete Edochie reveal say hin never hear from her since, especially since hin hear rumors about di mental challenges wey she dey face.
You fit go read di tori see wetin Pete Edochie tok on divorce rates…READ MORE