fbpx
May 18, 2024

Coup: Tinubu don order di close down of Nigeria Land Borders against Niger

tinubu-order-borders-close-down

Following di recent military takeover for Niger Republic, President Bola Tinubu don give order to close down of all of Naija land borders with di Republic of Niger.

Bashir Adeniyi Adewale, di acting controller general of di Nigeria Customs Service, announce dis development on Friday. He tok say e dey based on agreements wey di Economic Community of West African States (ECOWAS) make following di coup for Niger Republic.

After Adewale tour Nigeria border facilities with Niger for Katsina State on Friday, hin tell reporters for Jibia say di customs department don ready to follow di President directive as hin take tok am.

 

FOR MORE NEWS: Pete Edochie drag Ireti Doyle, and others for divorcing dia husbands

 

As hin note am say di implementation of di order go be 100 percent, di customs boss tok say dem go work with other security agencies to make sure say all inbound and outbound cargoes in and out of Nigeria no go dey allowed during di period of border closure.

As is pipo suppose sabi by now, President Ahmed Bola Tinubu na supporter of economic union for West Africa, according to am.

Also, hin get strong belief say to trade with our neighbors fit benefit Nigerians and other inhabitants of di  sub-region.

Ina ddtiotion, hin don expressed dis matter in words, and na dat one fit don help am become di leader of ECOWAS less than a month after hin become president of Nigeria.

You fit go read di tori see why Tinubu order borders to close down…READ MORE