‘If you must do Yahoo, target politicians’ – Rev Fr Oluoma tackle fraudsters
Famous Nigerian Catholic priest, Rev Fr Chinenye Oluoma don tackle Nigerian youths wey dey into fraudulent activities for Internet, hin yarn say dem no go end well.
Inside video wey dey posted on top hin official Facebook page on Tuesday morning, di priest wey tok during sermon, lament about how di internet fraudsters defraud innocent pipo of dia hard earned money. Also, hin yarn say e for better if dem target politicians.
Fr Oluoma yarn say although some music artists dey sing to endorse Yahoo, and hin say dat kain lifestyle no fit dey justified.
Hin yarn say when person pursue wealth at di expense of fellow humans, dem dey trash pipo to get treasure wey go be trash for dia life.
FOR MORE NEWS: FCT go reintroduce monthly sanitation to keep Abuja clean – Wike
In addition, hin yarn say hin no understand when pipo wey dey steal and dupe others go dey vex when ministers condemn am.
Yahoo na set of pipo wey go just lock themselves inside house, look for somebody wey dey vulnerable, kon use dia computers dupe di person of everything wey hin don labour for.
Hin tok say If person dey into such thing, make dem no marry because if dem marry and dem born pikin, dia children go suffer di consequences.
You fit go read di tori see why Catholic priest tackle Nigerian youths…READ MORE