fbpx
May 19, 2024

FCT go reintroduce monthly sanitation to keep Abuja clean – Wike

fct-to-reintroduce-sanitation-

Mr Nyesom Wike, Minister of di Federal Capital Territory FCT, Abuja, yarn say di ministry don conclude plans to reintroduce monthly sanitation as part of strategies to keep di city clean.

Wike tok dis one for Abuja on Monday, after closed-door meeting with contractors wey dey handle different projects for FCT.

He yarn say hin don already brief President Bola Tinubu on di idea say at least two Saturdays in a month na hin dem go declare for sanitation from 7a.m. to 10 a.m.

According to Wike, di move go allow companies wey dey support FCT with logistics to go market, and other public places to evacuate refuse.

 

FOR MORE NEWS: Cross River govt don suspend ‘quack pharmacists’

 

Wike yarn say if pipo want make Abuja dey clean, everybody need to cooperate.

Also, hin yarn say pipo must make sacrifices. Everybody need to contribute.

According to wetin hin tok, if person spare three hours on Saturday for house, to clear dirty, carry dem come out make dem evacuate and dispose am, e go follow help with di goal of making Abuja clean.

Hin encourage residents make dem cooperate with di government so dat dem go fit achieve dia goals.

Also, about di streetlights matter, di minister tok say some improvements dey already.

Hin assure pipo say everywhere for Abuja go get light.

You fit go read di tori see FCT plan to reintroduce sanitation…READ MORE