Updated: Spanish football chief Rubiales resign over kiss scandal
Spanish football federation Chief Luis Rubiales don resign following serious criticism for kissing Jenni Hermoso for lips during di Women World Cup victory ceremony.
Di already suspended Rubiales send hin resignation to di federation interim president. For inside open letter, hin explain hin decision to eventually step down on top television interview.
Hin tok for interview with television show “Piers Morgan Uncensored” say hin resign because hin no fit continue to work.
Rubiales spark worldwide backlash after hin kiss midfielder Hermoso during di medal ceremony following Spain World Cup triumph for Sydney on August 20.
Na as hin no gree resign, na hin FIFA suspend am for 90 days, while Spanish public prosecutors don file lawsuit against am for alleged sexual assault.
FOR MORE NEWS: ‘Strong leadership’ – Joe Biden hail President Tinubu
Hermoso, 33, bin follow file complaint for di National Court on Tuesday, hin formally accuse Rubiales of sexual assault.
Inside open letter wey Rubiales publish on Sunday night, hin tok say hin don inform di federation say hin dey stepping down as vice-president of European football governing body UEFA.
Also, Rubiales tok for hin letter say after di suspension carried out by FIFA, plus di rest of di procedures wey dey opened against am, e dey evident say hin no go fit return to hin position.
You fit go read tori see more on why Spanish football Chief Rubiales resign…READ MORE