fbpx
May 9, 2024

Morocco national team players donate blood to earthquake victims

morocco-players-donate-blood-to-help-earth-quake-victim

Morocco national football team players take break from practice on Sunday to donate blood to help victims of di kontri deadly earthquake.

A 6.8 magnitude quake wey strike southwest of di Moroccan city Marrakech, bin claim di lives of at least 2,012 pipo.

Di Interior Ministry yarn say least another 2,059 bin get injury, 1,404 dey in critical condition, as dem reveal say di quake wey happen na di strongest to hit di kontri in 120 years.

After di damage wey di quake cause, di Atlas Lions of Morocco wey suppose go play for Liberia in a qualifying match for di African Cup of Nations, announce on Saturday say dem don postpone di game with di agreement of the Confederation of African Football.

 

FOR MORE NEWS: Updated: Spanish football chief Rubiales resign over kiss scandal

 

Di video on top internet show say instead make dem take extra time to practice, di Morocco footballers players go donate blood to earthquake victims, and dem share di experience inside post on top X, wey pipo know as Twitter before.

Plenty players including Cristiano Ronaldo follow enter social media to give dia condolences to di victims.

Morocco star Achraf Hakimi write on top Instagram say na time for pipo to help save as many lives as possible. Also, hin send hin condolences to all di pipo wey lose dia loved one.

Forward Walid Cheddira for hin post write sayhin heart break for hin kontri. Also, hin tok say e no easy for pipo wey experience dis moment.

Ronaldo post grab di attention of Chinese football fans on di kontri Twitter-like platform Weibo, also, di footballer message kon become di trending topic on Sunday.

You fit go read di tori…READ MORE