Nigerian Farmers don lose 80% dia Crop Yield To Pests, Diseases for 2022 ― Report
Nigerian farmers don suffer about 80 per cent crop loss to pests and diseases for estimation of 1.5 to 200,000 hectares of land for 2022, report by National Agricultural Extension and Research Liason Services (NAERLs) na hin bring this update.
According to di report, di crops wey e affect pass na; maize, rice, sorghum, millet, soybean, groundnut, cowpea for thirty-three states including root and tubers, fruit and vegetables and tree crops.
Di 2022 Wet Season Agricultural Performance Survey for Nigeria show say Abia, Adamawa, Ebonyi, Ekiti, FCT, Kwara, Lagos, Nasarawa Osun, Plateau and Rivers states record more than 20 per cent crop post-harvest loss.
YOU GO LIKE READ: How to Educate Yourself on a New Subject
Report still show October this year, 34 out of di 36 States and FCT na hin flood affect. Di flood affect 1,411,051 pipo and about 500 na hin kpai because of di flood.
On top di matter, 1,546 pipo get injury, 37,633 houses, loss of livestock and crops for some farmland na hin dem report say flood destroy. Di states wey e affect pass na Adamawa, Anambra, Bauchi, Ebonyi, Jigawa, Kano, Kogi, Niger and Taraba.
Dr Mohammad Mahmood Abubakar for Abuja, di Executive Director of NAERLs, Prof Emmanuel Ikani call for aggressive mechanization and dry season farming so that dem go fit increase food production loss wey 2022 flood cause.
Di tori dey inside Tribune…click here go read di remaining tori…READ MORE
For more News: Terror Alert: FG dey talk with confidence as US say make Non-Emergency staff comot for Naija