fbpx
April 29, 2024

We don battle up to 131 fire outbreaks from Jan to Nov – Rivers Federal Fire Service

0

Di Federal Fire Service for Rivers State don come out tok say dey don combat 131 fire cases for di state since di beginning of di year 2022.

Di commanding officer of the Federal Fire Service for di state, DCF Abdul Alfa who gave di figure also tok say properties wey worth over N2.63bn na hin don lost for fire within period of 11month.

U FIT ALSO READ Kick Emefiele out, HURIWA Dey Advise NASS

According to him, hin tok say: “From January dis year to November, dey don fight up to 131 fire cases. from wetin dem record. Di expected property wey bin loss for fire casea go reach N2.63bn, den di expected property wey dem bin save from January to November 2022 na N18.1bn.”

Alfa  tok say: “ dey bin find am a little bit difficult to get to di scene of fire in good time because of other road users. If you see any fire vehicle coming with siren, without say dem tell you, you suppose know say di vehicle wan go attend to an emergency.

But most vehicles go block di road and refuse to give way and if such thing hapun e dey always affect dia response time ”

Hin still tok say “ The state government fit help dem create sensitization or awareness on-air so dat, if di citizens see any fire service vehicle dey come with siren, dey should know say di vehicle dey go to attend to an emergency.”

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *