Fuel scarcity don start again and pump price don increase
Fuel scarcity don start again for di federal capital territory, FCT, Lagos and other major cities. Despite di price increase from 179/per litre to N194/litre on Thursday, di fuel scarcity don bring long queues.
Report reveal say Nigeria National Petroleum Corporation Limited filling stations for Maitama, along Kubwa Expressway, Mega Station CBD change dia metres make e dey show di N194/litre pump price as of Thursday evening, while for Lagos, dem dey sell di fuel for N184/litre for NNPCL filling stations.
In reaction to this development, di Group Corporate Communications officer of di NNPCL, GarbaDeen Muhammad, open up say no be di company responsibility to determine petrol prices.
But, when reporters contact di spokesperson of di Nigerian Midstream Downstream Petroleum Regulatory Authority, NMDPRA, Mr Kimchi Apollo, hin no reply hin messages or texts. Di website too no show any notification of fuel price increase as of di time of di report.
FOR MORE NEWS: INEC power to return candidate dey dangerous — Ex-NBA boss
Di situation of fuel scarcity na something wey dey happen almost every time for Nigeria.
For all di major filling stations for Abuja on Thursday, na long queues full all of dem. Only two filling stations along the Kubwa expressway na hin bin dey sell fuel to motorists. DI situation na di same along diLugbe expressway.
According to Nigeria Minister of Finance, budget and planning, Zainab Ahmed, di current government plan to spend N3.23 trillion for fuel subsidies. E go happen from di month of January to June
You fit go read di full tori…READ MORE