fbpx
May 6, 2024

INEC power to return candidate dey dangerous — Ex-NBA boss

INEC-power-to-return-candidate-na-dangerous-act-

On wednesday, Chief Wole Olanipekun SAN don tok against di Section 65 of di electoral act. Di former President of di Nigeria Bar Association, yarn say INEC power to return candidate dey dangerous.

Olanipekun, wey tok say di act dey dangerous to politics and democracy, yarn say di returning officer no be court of law, no be  tribunal, and e no dey granted with jurisdiction to exercise over any matter wey dey judicial in nature.

FOR MORE NEWS: Tinubu wife to Nigerians – “pursue my husband comot if hin no perform well”

Di legal luminary chat with journalists for Ado Ekiti, di Ekiti State capital, after hin visit Governor Biodun Oyebanji. Hin yarn say INEC power to return candidate no go favour politics and democracy.

Di Chief Returning Officer wey be di  Chairman of INEC fit decide to withdraw himself put another person anytime.

Na why di legal luminary call stakeholders and political parties, say make dem monitor INEC and di returning officers so that nothing like that go happen.

You go like read di full tori…READ MORE