fbpx
May 19, 2024

Two soldiers under arrest for armed robbery and kidnapping for Abuja

two-soldiers-under-arrest-for-violent-crime-in-Abuja

Inside di Armed Forces of Nigeria, two soldiers dey under arrest for armed robbery and kidnapping for di Federal Captital Territory (FCT) Abuja.

This kain crime wey these two soldier under arrest do, don make di authorities of di Nigerian military dey worry. Soldiers wey suppose protect di nation na hin go involve himself for violent crimes.

Report from di platform, PRNigeria, yarn say di military hierarchy dey think with serious focus on which  serious and harsh action hin fit take to stop officers and men wey wan poil di image of di Nigerian Armed Forces.

FOR MORE NEWS: Public universities must charge better school fees because of government magu magu — Ex LASU VC

Na this week di hierarchy start to dey think of wetin e fit do, following di report of di two soldiers under arrest because of di crime of robbery operation for Post-Service Housing Development Limited (PHDL) phase one Estate inside Kurudu, somewhere for Abuja.

Also operatives of di Vigilantes Group of Nigeria on September 20, 2022 bin arrest one serving soldier, Nafiu Isah, dem collect one AK47 and 30 rounds of live ammunitions from am.

You fit go read di full tori…READ MORE