fbpx
September 28, 2024

“I go use di $50k buy land for my hometown” – Portable don continue hin criticism about TG Omori

portable-criticism-over-tg-omori-charge

Controversial street-hop singer, Habeeb Okikiola, wey pipo know as Portable, don continue hin criticism of video director, TG Omori regarding di price wey hin charge.

You go remember say some days ago, Portable called out di ace director because hin charge am $50,000 (N37 million) when he tell am say he wan di video for one of hin songs.

Portable no waste time enter hin Instagram story, as hin continue hin criticism with anger, hin still query TG Omori say why hin  go dey charge that kain plenty amout.

FOR MORE NEWS: Omori charge Portable $50,000 for music video – “Na ritualist you dey shoot video for?”

In addition, Portable share screenshots of dia chats for video, where hin replied to Omori with voice notes. For inside di voice notes, hin dey lament about di money, e tok say e too high.

For inside new video with some friends, Portable reveal say e better make hin use di money to buy acres of land for hin  community than pay TG.

Di “Ika of Africa” star repeat am dey e no dey possible for am to pay N37 million for music video when members of his family dey look up to him for dia daily feeding.

He claim say hin neva kolo reach di extent wey hin go make that kain horrible  mistake.

You fit go read di full tori…READ MORE