fbpx
November 15, 2024

“NUC no fit shut down schools for elections” – ASUU

nuc-tell-asuu-make-dem-shut-schools-for-elections-

Di Academic Staff Union of Universities ASUU on Tuesday yarn say e no dey di power of di National Universities Commission NUC and other tertiary institutions regulatory agencies to shut schools so that students for universities, polytechnics and colleges of education go vote during di forthcoming elections.

Na one member of di National Executive Council of ASUU and chairperson of di union for di Federal University of Technology, Minna, Prof Gbolahan Bolarin, na hin tok this one for interview.

Hin bin dey react to calls from individuals and groups, including di House of Representatives. Dem bin tok say make di nation higher institutions shut down during elections so that students wey register near dia house go fit go house go vote.

FOR MORE NEWS: Ondo University don get NUC approval for new course

He yarn say di NUC na just regulatory body. Also, dem no get di power to order di closure of any university. However, di only authority wey fit order this closure apart from di Senate of each institution na di Federal Ministry of Education and di order go come on behalf of di visitor to all di universities, and na di President be that.

In addition, hin tok say by di time di ministry give di order, di NUC go comply and di directives go dey passed down. Also, hin yarn say make House of Representatives talk to di President about di matter.

According to report, di House of Representatives last week Thursday pass resolution. NUC bin ask ASUU make dem shut down schools so that di students go fit take part for di forthcoming elections.

You fit go read di full tori…READ MORE