fbpx
April 28, 2024

Lecturers Gather Money Accredit Courses – Don Yan Tinubu

k-leg-for-public-universities

Dr. Tade Oludayo, wey be lecturer for University of Ibadan, don yan say e get k-leg for public universities for Naija. E yan dis one for one letter wey e send give President Bola Ahmed Tinubu, wey e title “A letter to President Tinubu on public universities,” wey DAILY POST see for Ibadan on Thursday.

Tade talk say lecturers dey use their own money make sure courses dey accredited by National Universities Commission, NUC, because plenti public universities no dey gree release money or dem just dey form say dem no get. E yan say na so e bad reach say some lecturers dey even use their money pay for things like door tags for the school, na di k-leg for public universities be dat.

E tell tori people say e get one time e colleague carry gen come school just to fit run class give students light. After dem use the same system fustrate am, e waka waka go another better place wey dem value beta.

 

FOR MORE NEWS: “Make you marry women wey dey earn pass you” – Daddy Freeze tell men

 

Tade yan say, “Mr. President, as I dey write, federal government still dey owe lecturers billions of naira for work wey dem do for more than six years.” Dis na money wey dem suppose pay lecturers for extra work wey dem do. According to Tade, e be like say government no wan employ more lecturers, so ASUU don make deal say make dem compensate those wey dey do pass their level until government fit employ more hands.

E con tell President Tinubu say make e put money for education, talk say developed countries wey dey shine for science and technology na because dem put beta money for education. Tade dey yan say public universities need quick attention and rescue.

You fit go read di tori of di k-leg for public universities….READ MORE