“Hin male side dey appreciate hin female side” – Netizens don react to Bobrisky fake N1m alert
Controversial Nigerian crossdresser, Bobrisky, don dey trend again for news after dem catch am say hin dey lie for social media, Di matter for ground na di fake alert wey hin send give himself..
Also, di crossdresser post screenshot of di credit alert for hin Snapchat page. E no too dey wey truth come out say that Bobrisky alert na fake.
However, di screenshot prove say na hin doing, as netizens get sharp eye, dem quickly notice say di money na from Bobrisky to himself.
E no stop there o, Bobrisky add say hin get di money because hin look beautiful and hin no spend di weekend for man house because of di money.
After pipo discover Bobrisky lie, hin quickly delete di post from hin Snapchat.
FOR MORE NEWS: Bobrisky anounce hin liposuction surgery plan for social media
However, that one no stop di tok for netizens mouth. Read some of DIA comments below:
nipple_swt_: “Mr man don quickly go delete am he forget say some people no Dey sleep.”
miebambini_plussize: “Transfer from me to me, Bob na werey.”
peterclaver_signature: “You don’t get it. His male side is appreciating his female side with 1m. Idris na man. Bob na female. Na confused goat him be sha.”
dubbyworld: “How do you transfer funds to yourself and act excited and surprised??? Bob lives off the internet.”
oluwakemi._o: “Bobrisky and lie 5&6”
pradaleesa: “Wahala for they allow social media pressure them.” weightgain_hub: “From Idris to Mummy of Lagos.”
You fit go see di full gist…READ MORE