fbpx
September 29, 2024

Spinless talkers – Federick Leonard don slam Nigerians over recent hardship

federick-leonard-tok-on-nigerians-hardship

One of Nollywood’s finest actors, Federick Leonard don call Nigerians spineless talkers due to di ongoing hardship for di  country.

Di Anambra-born Thespian drop this tok for hin instagram page.

This one dey come for di time when Nigerians dey go through fuel crisis, alongside shortage of di naira notes.

Also, Singer, Adekunle Gold bin don lament before say Nigerians waste 8 years of dia lives under di President Muhammadu Buhari administration.

FOR MORE NEW: “Buhari administration waste 8 years of our lives” – Adekunle Gold

According to Federick Leonard, Nigerians no dey receive better treatments from dia leaders upon di hardship because dem (leaders) know say di  citizens na “spineless talkers.”

Di acto wey recently marry hin fiancee, Peggy Ovire, yarn say Nigerians go need to fight for di betterment of di country. In addition, he yarn say freedom from oppressors no dey come cheap.

Hin yarn say indeed, pipo for this country na Spinless talkers. #These leaders know.

“As long as we remain spineless, Nigeria no go ever become better because freedom from bad and oppressive leadership no dey free. #WeAreNotReadyYet,” Na wetin hin tok be that.

You fit go read di full tori…READ MORE