Fuel Scarcity: Federal Govt Don Make Moves To Restore Normalcy
As part of plans to restore normalcy to di country after long petrol scarcity, di federal government yarn say dem dey work with all relevant stakeholders to find lasting solution.
Minister of state, Petroleum Resources, Chief Timipre Sylva, wey tok to newsmen shortly after dem inspect some filling stations for di Federal Capital Territory (FCT), give assurance say dem don resolve di issues.
Di minister yarn say 14-man committee, wey dey part of di solution mechanism, go dey inaugurated next week, and about di fuel scarcity wahala, dem go try restore normalcy to di situation totally.
Remember say President Muhammadu Buhari recently approve constitution of 14-man Steering Committee on Petroleum Products Supply and Distribution management to find lasting solution to di disruptions in distribution of petroleum products.
FOR MORE NEWS: APC dey find fresh mandate: Insecurity, poor electicity and fuel scarcity still dey di country
Chief Sylva, wey inspect some filling stations for FCT, including Conoil and TotalEnergies filling stations for Central Area, to assess di level of supply, express hin satisfaction say di scarcity don dey under control.