fbpx
May 19, 2024

APC dey find fresh mandate: Insecurity, poor electicity and fuel scarcity still dey di country

apc-dey-find-fresh-mandate

For di year 2015, di All Progressives Congress, APC, campaign like say tomorrow no dey with di state of di nation under the Peoples Democratic Party, PDP, administration. Upon all di wahala wey Nigerians dey face, APC still dey find fresh mandate.

Reports yarn say di  change wey everybody bin  dey tok, work like magic, as Nigerians line up to support di party and dem vote President Muhammadu Buhari into power.

But, e remain few weeks to di 2023 general elections, di things wey make pipo remove PDP that time,still dey happen for di country.

Before di 2015 election, APC leaders travel for all di 36 States and di Federal Capital Territory (FCT). Dem dey lament over di level of insecurity, poor power supply, fuel scarcity, high dollar rate, and others.

President Muhammadu Buhari bin win di race against ex-President Goodluck Jonathan.

FOR MORE NEWS: Abia Governor Don Announce Public Holiday For PVC Collection

But one month to di presidential battle,  APC dey find fresh mandate, and all di thing wey dem tok say dem go fix before di 2015  election, nothing don change at all.

Di ruling APC wey dey find fresh mandate bin tok say dem go bring change. Now, di reason why dem comot PDP that time, all of dem still dey. Dem no fix anything.

Plenty communities and local government areas still dey under di threat of Boko Haram, Islamic State of West Africa Province (ISWAP), bandits and unknown gunmen.

Nigerians still dey face  over reduced electricity supply, APC still dey find fresh mandate

Di Capacities of di 26 power-generating plants out of 29 for di country don drop by 25 percent.

On top di matter, fuel scarcity start again one week into di new year.

Nigerians dey stand for queue for hours to buy Premium Motor Spirit (PMS) for dia vehicles and generating sets.

Dem dey sell one litre of fuel for  N300 inside most filling stations. Black market price dey stand for  N500 per litre.

On Sunday, one APC member, Ayobami Oyalowo react to di matter. She say even as di country neva overcome di challenges, di setbacks no dey impossible.

Oyalowo insist say  Tinubu na di best candidate to succeed Buhari.

You fit go fit di full tori…READ MORE