CBN Grant RoutePay Licence To Provide Digital Payment Solutions
Di Central Bank of Nigeria CBN don grant Full Operating Licence to RoutePay Fintech Limited to provide digital payment solutions for Nigeria.
Also, for inside di letter by the apex bank to RoutePay titled, ‘Payment Solution Service Licence Category’ and date January 12, 2023, dem yarn say, dem dey pleased to give di information say di CBN don approve di issuance of licence to operate under di Payment Solution Service Provider (PSSP) for Nigeria.
Di CBN approval follow a painstaking review and updates including on the spot assessment of facilities for di fintech firm to ensure say dem meet developments for di payment ecosystem.
FOR MORE NEWS: Online Marketing Tips For Furniture Business
Although di CBN grant RoutePay di Licence and Approval In Principle (AIP) last year. With this full approval, Routepay dey certified to fulfill all di conditions wey di CBN don specify.
RoutePay according to Mr. Femi Adeoti dey managed by a team of intelligent professionals. Dem get deep knowledge and understanding of di digital payment systems for Nigeria. Adeoti yarn say di CBN approval validate di firm trustworthiness for di financial services industry.
Also, hin highlight di growing need for improved processes, services, products and accessibility. This na for di digital payment and financial technology industry. Adeoti yarn say Routepay na to make sure say digital payment solutions dey possible and available for di environment without wahala.
You fit go read di full tori…READ MORE