fbpx
May 18, 2024

Serie A: Osimhen dey happy as hin make history with Napoli

osimhen-make-history-with-napoli

Victor Osimhen dey happy to make history with Napoli after hin score two goals for di Sunday 3-0 win against Spezia.

Di Nigeria international score two times for di second half to continue hin impressive scoring spree for di Partenopei.

Also, di 24-year-old increase hin goal move to 16 from 17 league outings this season.

Osimhen na di fourth Napoli player wey go score 16 goals for di first 21 Serie A games of di season following di footsteps of Luis Vinicio for 1955-56, Edinson Cavani for 2012-13 and Gonzalo Higuain for 2015-16.

Di forward tell Sky Sports Italia say dem bin need di points to keep di momentum going. Also, Osimhen tok say hin dey happy with di win and of course, to make history books of Napoli na great privilege for am.

Napoli dey on course to win di first Scudetto in 33 years and to enjoy a 13-point lead for di top of di standings.

You fit go read di full tori…READ MORE