Fuel scarcity, currency swap: For Nigerians, na double wahala
For di last few weeks, Nigerians don experience serious hardship as a result of di twin problem of fuel scarcity and cash crunch wahala.
Remember say in November 2022, long queues start for filling stations across di country due to di unavailability of fuel for some filling stations while di pipo wey get di petroleum product sell dia own at N240, and that price dey N85 above di pump price of N165 wey dey approved by di Nigerian National Petroleum Company (NNPC) Limited.
Di Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria (IPMAN) don attribute di fuel scarcity wahala and price increase wey Nigerians dey face to di depot price increase wey go from N148 to N200.
According to di National Operations Controller of IPMAN, Mike Osatuyi, “Unlike before when past members lift di product to N148 per litre, now, dem lift am to N200 per litre. So, e go dey impossible for them to sell petrol for di normal price wey be N165 per litre.
According to Mike Osatuyi, dia members pass through too much difficulty to get di product this time. Also, di marketers spend much to take di product to plenty parts of di nation because of di high cost of diesel, wey dem dey sell now at about N800 per litre.
You fit go read di full tori….READ MORE