fbpx
May 15, 2024

CBN Don Give Update on PoS Charges, Dem Go Work With Banks to End Cash Crunch

cbn-to-review-pos-charges-with-banks

Di Central Bank of Nigeria (CBN) don ask Nigerians make dem remain calm as dem dey work with di commercial banks to review PoS charges and to reduce di pains wey Nigerians dey feel. This na beacause of di line up for ATM points and di charges wey PoS operators dey call for customers as a result of di scarcityof cash. Di CBN, Governor, Godwin Emefiele announce give this update for media briefing on di new naira note for Lagos.

Di apex bank governor plead with Nigerians for time to fix di setbacks wey dey associated with dicirculation of di newly redesigned notes.

FOR MORE NEWS: CBN Grant RoutePay Licence To Provide Digital Payment Solutions

Emefiele yarn say for dia meetings with di banks, dem don tell banks to set up tents and chairs, and dem go give pipo numbers. Also, hin tok say pipo fit complain say di style dey old-fashioned. However, at this time wey dem dey try circulate di new amongst everybody, people go need to get numbers and dem go come under di queueing arrangements. that when you come in you get served, if it finishes, just be patient.

Emefiele add say CBN go call for meeting with di banks to review PoS charges to allow Nigerians get di new notes. Hin still tok say dem go comot di withdrawal limits and pipo fit go back to conduct dia businesses as e dey before, di News Agency of Nigeria na hin report this one.

You fit o read di full tori…READ MORE