fbpx
April 28, 2024

“My return to APC no go cause wahala” – Abe

Abe move no go cause wahala

Senator Magnus Abe don yan say hin move from Social Democratic Party (SDP) go All Progressives Congress (APC) no go cause any wahala inside the party.

You fit remember say Abe bin waka enta SDP afta wahala waka enta between am and former Governor of Rivers State, Rotimi Amaechi, wen e no fit win APC ticket.

Abe, wey represent Rivers South East Senatorial District, later waka enter SDP come become governorship candidate for di 2023 election.

 

FOR MORE NEWS: Portable buy new Lexus worth over 30 million naira after one door close.

 

E yan journalists for Port-Harcourt say: “My message don dey the same, say we all gats come together, work together to fit get di expectations wey our people get.

“So, basically I call my people today to tell dem about some of di ongoing mata and also to let dem sabi say we dey return back to All Progressives Congress, to join other well-meaning Nigerians to support President Tinubu government and also make sure say Rivers people dey part of the development wey dey center and also carry the state along for wetin we dey do.”

E come yan about fear say hin waka fit cause kasala inside APC for the state, Abe talk say e get good relationship with di Chairman of di Caretaker Committee of APC for Rivers State, Tony Okocha.

“I believe say di responsibility to make peace inside di party na for all of us wey be members of di party, no matter di position wey we get or we no get.

“Tony Okocha don be member of our team as everybody sabi. If today e be Chairman of di party, na decision wey national make, so make e be.

“But we no dey inside APC because of any particular person. We dey APC because we be founding members of di party, and we be grassroots supporters of di president.

Abe move no go cause wahala, You fit go read di tori…READ MORE