fbpx
May 12, 2024

Afenifere dey drag INEC for disobeying electoral guidelines

afenifere-dey-drag-inec-for-disobeying-electoral-guidelines

Di pan-Yoruba socio-political organization, Afenifere don drag INEC for disobeying di electoral guidelines regarding di 2023 elections.

AFENIFERE

Di socio-political organization earlier condemn di declaration of results for di All Progressive Congress (APC) candidate, Bola Tinubu by INEC after di elections dey over.

In addition, di organization Afenifere, yarn say di  Independent National Electoral Commission INEC no stick to electoral guidelines.

FOR MORE NEWS: March 11 polls: Confusion dey everywhere as INEC postpone state elections

After di meeting wey di organisation hold, dem release communique.

Na wetin di communique tok be dis; “Di deliberate non-compliance by di Commission with these mandatory guidelines encourage electoral brigandage for di polling units wey include di destruction of ballot papers, snatching of ballot boxes, doctoring of figures and swapping of votes of candidates for di  coalition centres by amended and outlawed manual procedures wey make di 25th February 2023 Presidential and National Assembly elections get error as confirmed by local and international observers.

Also, according to di organisation, di results of di lawful votes for di election available to di Afenifere through credible sources confirm say His Excellency Peter Gregory Obi, di Presidential candidate of di Labour Party na hin win di said election and we support hin decision to challenge di contrary Declaration by di INEC.”

For inside statement, di group dissociate Afenifere from any congratulatory message. 

You fit go read di full tori…READ MORE