fbpx
April 28, 2024

Governorship election: YPP collapse dia structure to PDP for Benue

ypp-collapse-dia-structure-to-pdp

Di Young Progressives Party YPP, for Benue State, don collapse dia structure to di Peoples Democratic Party PDP ahead of di March 18 governorship election.

YPP Chairman, Dr Gwadue Hough, na hin drop di update say dem don collapse dia structure to PDP on Thursday for Makurdi.

Di YPP don go into alliance with di PDP so dat Mr Titus Uba, di PDP governorship candidate go win di gubernatorial election. Na wetin hin tok be dat.

Also, di chairman yarn say di party don decide to align with di PDP on governorship position. He stress say if di party stood alone e no go fit win di election though e fit get over a 100,000 votes.

FOR MORE NEWS: Crude oil sales rise by 46% to N21tn – NBS

According to wetin di chairman tok, na because of dat dat matter na hin dem reduce di unforeseen disaster.

Hin yarn say dem don  go out to contribute dia quota to di building of di state for di next four years.

However, he yarn say di party no go waste time to stand against PDP when e fail for her social engagements with diBenue people.

Also, hin say di alliance  no suppose be parasitic type but mutual one wey go dey beneficial to all.

In addition, he encourage members of di party make dem work with great perseverance as if dem get governorship candidate for di race. Hin yarn say if dem work together, e go make PDP win di election.

Also, hin commend Gov. Samuel Ortom for his sensible leadership and hin developmental strides for di state.

You fit go read di full tori…READ MORE