fbpx
May 5, 2024

Akeredolu Don Return From Germany

akeredolu-return-from-germany

Ondo State Governor Oluwarotimi Akeredolu don return home from Germany after hin spend three months for hin medical leave.

Akeredolu don comot go Germany for about three months to treat ailment wey hin no reveal.

On Friday, report gather say di governor go move from Lagos airport go hin house wey dey Ibadan and hin go stay for a few days before hin come Akure, di Ondo State capital.

Ahead of hin arrival, hin press crew yesterday comot for Akure go Lagos to receive am for di airport.

Also, as Akeredolu Return From Germany, some source tok say di governor go dey briefed by hin cabinet members on arrival to di state.

 

FOR MORE NEWS: BREAKING: At least 49 pipo don kpai as terrorists attack passenger boat

 

One viral picture of Governor Akeredolu inside di airplane wey hin board on hin way to Nigeria surface online yesterday.

As of di time of filing dis report, some of hin cabinet members bin dey for Ibadan, di Oyo State capital dey wait for hin arrival.

Di governor start hin medical leave in June wey kon dey extended indefinitely by di state House of Assembly.

However, di governor bin transfer power to hin deputy, Lucky Aiyedatiwa, in line with constitutional provisions.

Photographs and video of di governor for German hospital appear online when he celebrate hin 67th birthday.

Inside di video, di governor bin dey dance with hin wife and associates.

You fit go read di tori…READ MORE