fbpx
May 5, 2024

BREAKING: At least 49 pipo don kpai as terrorists attack passenger boat

islamist-militants-attack-boat

Islamist militants attack river boat for north-eastern Mali, and dem kill at least 49 civilians, na wetin di interim government tok be dat.

Also, according to di reported dem attack army camp, and dem kill 15 soldiers, while around 50 militants don kpai.

Di government don declare three days of national mourning.

As e be so, di Islamist threat na matter wey dey grow despite claims by di military say di Russian Wagner Group mercenaries dey turn di tide of dia campaign.

Di northern city of Timbuktu don dey under blockade since di end of last month and attacks dey on transport.

 

FOR MORE NEWS: Gabon President, Ali Bongo No Dey House Arrest Again – Junta

 

Also, di BBC bin no fit verify di government latest report, wey dem read out on national TV.

Militants bin reportedly attack di boat as dem dey travel go River Niger from di town of Gao to Mopti, same thing with di Militants army camp wey dey di Bourem Circle for di Gao region.

Di Malian army tok for social media say di boat bin dey attacked around 1100 GMT by “armed terrorist groups”.

Also, di boat operator, Comanav, tell AFP news agency say di vessel bin dey targeted by at least three rockets wey target di engines,

You fit go read di tori about di Islamist militants wey attack passenger boat…READ MORE