fbpx
May 19, 2024

Oyo traditional ruler, Alakufo don kpai at 107

alakufo-of-akufo-don-die

One traditional ruler for Oyo State, di Alakufo of Akufo don die.

Di late Oba Hamed Olabamiji Olatunji Thomas be one of di traditional rulers for di Ido Local Government Area.

Akufo na one of di prominent towns for Ibadan, di state capital, wey dey known for di possession of traditional powers and brave men and women.

Akufo wey falls within Ward 2 for Ido local government area play significant roles during di Agbekoya struggle.

Also, one source wey dey close to di town reveal on Wednesday say di traditional ruler die last Wednesday.

 

FOR MORE NEWS: Shey na true? Tinubu return Nigeria with “charging port” – Charly Boy dey ask

 

In addition, di source yarn say di traditional ruler, Alakufo of Akufo don die. And hin die at di age of 107, reigning for 37 years.

He maintain say dem wan hold one-week prayer for di ruler soul inside di town today.

Also, di man yarn say hin no know why di tori no enter news. Di man die last Wednesday, and one week prayer na hin dem dey hold today.

“He died at the age of 107 and he reigned for 37 years. And he was a Muslim. He has been buried according to Islamic rites”. Na wetin hin tok be dat.

You fit go read di tori…READ MORE