fbpx
May 7, 2024

Shey na true? Tinubu return Nigeria with “charging port” – Charly Boy dey ask

tinubu-return-Nigeria-with-charging-port

Veteran Nigerian singer, Charles Oputa, wey dey known as Charly Boy, don raise alarm say di President-elect, Bola Tinubu return to Nigeria with “charging port” to prevent hin health from failing.

According to report, Tinubu reach di Nnamdi Azikiwe Airport, Abuja, on Monday afternoon from France where hin go on vacation for more than a month.

After dat time, some pictures surface online. Di pictures show plastic syringe wey dey di elbow joint of di former Lagos State governor. And di matter dey make plenty pipo suspect di tube to be wetin dem call peripherally inserted central catheter (PICC line).

 

As di matter be now, Tinubu and hin spokespersons neva debunk or confirm say di President-elect don undergone medical treatment abroad and hin come back with tube.

But reacting to di viral photos, Charly Boy yarn say e go dey disastrous if di pictures na true.

Inside hin tweet, hin write, “Wahala wahala wahala.

“I hear say Asiwaju Bola Ahmed Tinubu don come back & that hin get charging port in case battery run down.

“Is it true?

Shey na true? Tinubu return Nigeria with “charging port”

You fit go read di tori…READ MORE