fbpx
April 27, 2024

All labour lost… as court carry Diezani properties gives FG

0

Federal High Court wey tanda for Abuja don finally give the Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) the full authority to put leg on top properties of before before Minister of Petroleum Resources, Mrs. Diezani Alison-Madueke wey Abuja.

Remember say, the minister don run komot for Naija since former President Jonathan don loose 2015 election to President Muhammadu Buhari.

Inside the judgment wey the court deliver yesterday for Abuja, Justice Mobolaji Olajuwon order say the two houses and two motor wey the money fit tear pocket– to become Federal government properties permanently.

6 Ways To Make Money Online in Nigeria: The Ultimate Guide

The two house wey dey  Plot 1854 Mohammed Mahashir Street, Asokoro, and 6, Aso Drive in Maitama, which the EFCC don check the money to be $2,674,418 and N380,000,000 now don become Federal government own.

The motor too follow join, a black BMW saloon with chassis number B8CV54V66629 and registered number (Abuja), RBC 155 DH and a black Jaguar saloon car with chassis number SAJAA20 GRDMv43376, valued at N36,000,000.

Who go come buy all this properties, hope say e no go be “rob peter pay paul” well we dey here dey look.

You like READ MORE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *