fbpx
December 23, 2024

APC don commend Emefiele on extension of naira swap deadline

apc-don-commend-godwin-emefiele

Di Presidential Campaign Council, PCC, of di All Progressives Congress, APC, don commend Godwin Emefiele, di Governor of di Central Bank of Nigeria, CBN, for extending di deadline for changing old naira notes to new ones.

Earlier today Sunday, di CBN governor bin announce di deadline extension so that enable Nigerians go fit swap dia old notes for new notes.

Although, CBN bin don insist say dem no go extend di deadline for di swapping of old notes for new notes  wey suppose to end on January 31, but later di pressure and di difficulties wey Nigerians dey experience from getting di new notes via ATMs and over the counter from banks don make dem extend di date.

FOR MORE NEWS: President Buhari don pledge to eliminate any wahala wey di currency swap go cause.

According to statement by APC PCC Director, Media and Publicity, Bayo Onanuga on Sunday,  hin yarn say di extension go enable Nigerians, especially pipo for rural and remote areas, make dem get more time to change dia old notes and to prevent di panic wey for follow.

Meanwhile, for di statement, APC commend di Central Bank of Nigeria and Governor Godwin Emefiele as dem listen to di voice of well-meaning Nigerians on di need to extend di deadline for change of old N200, N500 and N1000 notes to di new ones.

Di campaign follow commend President Muhammadu Buhari as hin approve di extension and for hin leadership and statesmanship.

You fit go read di full tori…READ MORE