fbpx
May 19, 2024

11 pipo Burn To Death For Ondo Auto Crash

ondo-auto-crash-death-11-pipo-don-kpai

Eleven pipo don burn to death for inside fatal motor accident, Auto Crash wey happen for Soka Bridge for Ore, di headquarters of Odigbo local government area of Ondo State on Sunday.

Di Ondo Auto Crash accident, wey involve trailer and a Marcopollo bus, happen because of trailer wey dey drive for one way, and e cause di death of pipo wey bin dey di  motor.

According to one eye-witness, di trailer pass one-way and for di process, e collide with di Marcopollo bus wey dey come from Benin road.

As that one happen, immediate, di bus catch fire.

FOR MORE NEWS: Number of deaths for Nasarawa bomb explosion don increase to 56

Di Federal Road Safety Corps (FRSC) Unit Commander in Ore, Mr. Sikiru Alonge, follow confirm di incident.

Also, Mr. Sikiru Alonge yarn say di incident cause traffic congestion along di route and all 11 dead passengers burn beyond recognition.

Hin still yarn say dem dey do everything within dia power with other security agencies to remove di vehicles wey crash from road.

However, hin advise motorists say make dem always obey all traffic rules to prevent further tragedy.

You go like read go read more of di tori…READ MORE