fbpx
June 17, 2024

President Buhari don pledge to eliminate any wahala wey di currency swap go cause.

buhari-yarn-say-no-government-fit-solve-nigeria-problems

President Buhari give assurance yesterday as hin dey react to reports of long queues of pipo wey dey wait for hours to deposit old notes and to get new ones. Di matter don dey trigger public anger and criticism.  Although, di president assurance be say wahala no go come out from this currency swap.

For statement issued by di presidency spokesman, Malam Garba Shehu, President Buhari yarn say di currency swap dey target pipo wey dey hoard illegal money. He tok say no  be for common man. President Buhari yarn say di currency swap dey necessary to prevent counterfeits, corruption and terrorists funding. 

Hin assure say Nigerians say di change go stabilise and strengthen di economy.

FOR MORE NEWS: Naira notes redesign: ” Di target na elites wey dey hoard illicit funds, no be common man – Presidency

In addition, hin take note of di poorest section of society, di assurance wey e give citizens be say government no go leave them to dia own fate.

According to di presidency,  Central Bank of Nigeria and all commercial banks dey bring some initiative. This initiative go  speed up di distribution of di new notes.

You fit go read di full tori…READ MORE