fbpx
May 19, 2024

Igbo must support presidency for PDP: Investment of 24 years for PDP no fit just enter dustbin overnight.

igbo-must-support-presidency-for-pdp-

One chieftain of di Peoples Democratic Party, PDP, and former minister of aviation, Osita Chidoka, yarn say make South-East geo-political zone support di party for di 2023 elections. Hin claim say e no dey wise for Igbos to leave di party wey dem dey support since 1999, Igbo must support presidency for PDP.

Chidioka follow claim say di Labour Party presidential candidate, Peter Obi, wey com from di zone, go disrupt PDP dominance for di South East.

FOR MORE NEWS: APC dey find fresh mandate: Insecurity, poor electicity and fuel scarcity still dey di country

Hin make di statement on Sunday as hin dey answer questions for di Channels Television Sunday Politics programme.

Chidoka yarn say Igbo position for am be say dia significant investment for di PDP for 24 years no fit just enter dustbin overnight. Hin tok say hin go remain for PDP, and many Igbos remain for PDP, so Igbo must support presidency for PDP.

He add say advocates of Igbo presidency outside di PDP no dey wrong, but e maintain say di main opposition party na di shortest route for di Igbos to secure presidency.

You fit go read di full tori…READ MORE