fbpx
April 26, 2024

Army don dismisses 2 soldiers wey kill Islamic cleric

0

Nigerian Army don sharperly dismiss two soldiers wey join hand kill one Yobe State Islamic scholar, Sheikh Muhammad Goni Aisami.

The man bin dey travel from Gashua for Yobe when he see one soldier for road wey him name be Lance Corporal John Gabriel and he decide to show love as good Nigerian to help the soldier reach where him dey go.

As them dey approach Jajimaji, the soldier kon tell  the cleric say, e dey hear some kind strange car for the motor, na so the Islamic scholar pack for road may him check wetin dey make the sound. As e check see say nothing dey wrong with the moto, as he wan enter the moto back na so the soldier man take shoot the man.

But this time lucky no dey their side as wetin dem do for secrete later come dey expose.

Before dem dismissal the two suspect so, we bin hear say dem don demote dem from Lance Corporal to private. After that one, dem later collect rope from the neck, which dey in line with the military law.

The commander wey dey in charge of their matter bin add join am say, the command go soon carry their matter give Damaturu for prosecution according to Naija Law.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *