fbpx
April 25, 2024

ASUU talk say dem no call state versities quack.

0
ASUU\President\say\he\no\call\state\universities\fake\

ASUU President don make everybody know say people just misinterpreted wetin he talk, but no be wetin he mean be that.

 

The Academic Staff Union of Universities, ASUU, don talk say dem no call government state universities  quack.

 

Daily post report talk say plenty social media platforms don dey react to the thing wey dem say ASUU president talk.

 

Dem say ASUU President, Professor Emmanuel Osodeke dey yeye state universities and he say make people no take am serious.

 

Remember say Professor Osodeke bin appear for Arise Tv on Thursday. Na for there  he address some issues about the ongoing industrial action wey ASUU  start  over six months ago.

 

I go quote the thing wey the man talk wey make people dey react everywhere for social media.

 

ASUU president said, “talk about important universities not those quacks. They’re not part of our strike”.

 

You fit also enjoy this one: Oil Theft: How security operatives, govt officials dey run bunkering cartel

 

Na that statement na im make people dey think say ASUU president call other government state universities quack. But the man don come outside talk say na lie, he no talk like that.

 

As the matter take be, other state university wey hear this talk don already vex. Dey no wan know wetin e mean, dia own be say, why the man for talk like that. 

 

Professor Adebooye kon talk say the State university get 481 full-time academic staff and among them, 387 be full-time Ph.D. holders, “this is not a quack.” (No be quack be that)

 

As dem talk with DAILY POST on Saturday, the ASUU president don deny am, he say the report no be true, na people no understand wetin he talk. 

 

To find out more of this tori, CLICK HERE.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *