fbpx
April 26, 2024

ASUU STRIKE: Business wey dey university area don drop, owner dey loss money.

0
ASUU\STRIKE

One area wey dey always bubble for di temporary site of di university of Abuja do dey like ghost town since February. The name of di area na Mega Screen.

Di students wey dey make that place get life dey house. All of them dey house sey wait for when dem go hear news say ASUU don end strike.

Alhaji Bagudu and other plenty petty traders, Mai Suya, Mai Shai and others sef dey follow wait for news on di strike. Dem want make ASUU call-off of di strike because dia businesses depend on the students.

YOU FIT LIKE TO READ THIS ONE: Tips to Maintain a Good Relationship with Your Customers

When dem first announce the strike for February, some students no go house because dem think say e go be short break. But after some times, some of dem kon dey go house.  Mr Bagudu tok say dem no dey open shop again because dem no dey even fit make enough money for dia transport.

Di attention don dey on students wey never resume school since because of di strike and di staff of di university.  People no remember say business wey dey di school depend on di students to sell dia market.

You fit CLICK HERE go read more of di tori.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *