fbpx
May 5, 2024

Atiku don file fresh suit for US Court over Tinubu academic records

atiku-fresh-suit-for-us-court

Presidential candidate of di Peoples Democratic Party, PDP, for di last general election, Atiku Abubakar, don file fresh case for di US District Court for di Northern District of Illinois, United States, against President Bola Tinubu after hin withdraw di existing one before a circuit court for Illinois.

Remember say di kontri court for Illinois bin dismiss di suit filed by Atiku, seeking di release of di academic records of Tinubu for di Chicago State University.

Atiku drag di Chicago State University (respondent) before di court, hin seek order wey go make di respondent release di academic records of Tinubu wey dey dia possession.

However, according to Phrank Shaibu, Special Assistant on Public Communications to Atiku, di dismissal follow principal withdrawal of di suit.

 

FOR MORE NEWS: Italy don call on ECOWAS make dem extend Niger ultimatum

 

Arisenews reports Shaibu tok dis one on Sunday in reaction to enquiries about di dismissed suit by di Circuit Court of Cook County.

Shaibu yarn say, “Waziri Atiku Abubakar only withdraw di case before a Circuit Court of Cook County, Illinois County, United States of America because hin dey pursue di same matter for higher higher court and hin wan avoid abuse of court processes. So, dis na just di beginning.”

He add say e dey funny say Tinubu and hin supporters rejoiced over di development as if na Supreme Court judgement.

You fit go read di tori of Atiku fresh case for US court…READ MORE