fbpx
May 18, 2024

Italy don call on ECOWAS make dem extend Niger ultimatum

italy-don-call-on-ecowas-to-extend-reinstatement-

Italy don call on ECOWAS, dem tell di Economic Community of West African States (ECOWAS) make dem extend di deadline for di reinstatement of Niger ousted president.

According to NAN, Italian Foreign Minister Antonio Tajani give di advice inside interview wey dem publish on Monday.

Tajani tell La Stampa newspaper say di only way na di diplomatic one. Also, hin hope say di ultimatum of di Economic Community of West African States (ECOWAS), wey expire last night go dey extended today.

 

FOR MORE NEWS: Nigeria Air go start full Operation in October

 

Niger close dia airspace on Sunday until further notice over di reported threat of military intervention from di West African regional bloc.

Dem report di threat after di coup leader reject di deadline to reinstate di kontri ousted president Mohammed Bazoum wey still dey  detained.

You fit go read di tori see why Italy call on ECOWAS…READ MORE