fbpx
May 19, 2024

Atiku no go fail Ndigbos, Emma Umerah tells pipol of Anambra

0

As Atiku Abubakar don visit Anambra State to flag off hin presidential campaign for di 2023 general elections, One PDP chieftain and member of Atiku Presidential Council, Emma Umerah.

Umerah don come out thank di pipol of Anambra and South East region, in general, for di turn out and support to vote for di PDP presidential candidate.

U FIT ALSO READ Chieftain: North go give APC 12m votes – Bako

Hin tok say Atiku Abubakar bin get di interest of di Ndigbo for heart and him no go fail dem at all.

Umerah don assure South East pipol say di Atiku Presidency go address di issue of marginalization which di Ndigbo pipol don dey cy for.

Hin tok say Atiku love Igbo pipol base on say hin see himself as part of dem, and hin promise not to work against di interest of Ndigbos.

Umera don call on di pipol of the South East zone to vote for Atiku, and hin assure dem say di Presidency go greatly benefit dem both in appointment and infrastructural development.

Wen dey ask am about di disagreement beetwin di party leaders and di five governors group, hin tok say assurance dey say dem go reconcile with dem and bring dem back to join di campaign train bifore di elections for February.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *